
VERSE 1
I sabi dey sing with sweet voice
 My song dey make people dey rejoice
 My brother sabi how to make noise
 Stand up comedian na him career of choice
 My neighbour sabi how to dance (dance)
 If you dey watch him performance you must clap your hands
 Another one sabi football, wow!
 We dey tell am say one day you go make us proud
REFRAIN
 God give you something wey dey make you  stature
 And many things wey dey draw attention
 No hide yourelf again because I know that God has made you a star
[CHORUS:]
 A star (3x)
 A star (3x)
 A star (3x)
 I believe say you be star
 A star (3x)
 A star (3x)
 A star (3x)
 I believe say you be star
VERSE 2
If na how to sweep ground you sabi
 He no mean say na there your life go reach
 And if you look  yourself deep you go see
 Say you fit open company wey dey clean the street
 Bros! E no  matter wetin you sabi do
 Another person get the thing wey him sabi too
 So, swallow your pride and get to work
 Open your ears make you hear wetin my song dey talk