PRINCE NICO MBARGA: Sweet Mother

sweet mother

Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
 
When I dey cry, my mother go carry me,
She go say my pikin wetin you dey cry o yo
Stop stop, stop stop, stop stop make you no cry again
When I want sleep, my mother go pet me
She go lie me well well for bed
She cover me cloth, sing make you sleep
Sleep sleep my pikin oh
When I dey hungry, my mother go run up and down
She dey find me something wey I go tchop oh
 
Sweet mother, sweet mother oo