
The most reliable platform for presenting the best of Nigeria – positive diplomacy and foreign relations news; diplomatic strategy; international development jobs; policy review; value inspired role models; good music, humour, art and culture; history, etc.
As you dey torture me so
As you dey break my heart
As you dey do the thing wen you dey do me, dey do me
As you dey rip my pride, and dignity away
As you dey make me dey suffer
As you dey make me dey suffer
You no fit tell me say you no know wetin you dey do me
You no fit tell me say you no know wetin you dey do me
You dey kill, you dey steal, you dey lie, dey betray you dey kill
Dey make my pickin dey suffer, you dey make,
poor man dey, suffahead, suffahead
Na only rich man dey gain
You no fit tell me say you no know wetin you dey do me
You dey break my heart
As you dey so
U dey bow ur head
As u dey there so
U dey shed those tears
My broda make u stand up
This life u got nothing to loose
My sister make u wake up
Journey wen u don waka no be in vain
Me I know say
You dey work well well
You don sweat well well; suffer suffer well well
Waka waka well well
Why my people dey suffa for this Naija
Why my people dey suffa for Africa
For the people of the ghettos
Na blood shed and sorrow dey rain
Dem don blind our eyes with dem wordly things
Say the battle never finish oh it just begins
Saro-Wiwa talk am, Azikiwe talk am Awolowo talk am
U na no dey hear u fit kill the messenger
But u no fit kill the message
Kill me messenger, u no fit kill the message